11 weda dem bi Jew or Gentile, wey dey serve God with dem, like pipol from Krete and Arabia, all of us dey hear, as dem dey use awa language praiz God!”
My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.
Wi nor go hide dis trut from awa shidren; wi go tell di next generashon about di good-good tins wey God do, en pawa and di wonderful tins wey dey sopraiz us.
Make una look on-top di hills and una go si sey e nor get anywhere wey una neva do ashawo! Una sidan for road dey wait men, just as Arab pipol dey wait for dia enemies for desert. And naw, una don spoil di land with una ashawo and wiked life.
Bikos di place where ship dey pak put wen dem si, nor good for kold weda; some for di pipol kon gri sey make wi dey go. Dem dey hope sey wi go fit rish Foenix, wey dey Krete, wey face sout-west and nort-west, so dat wi go fit spend kold sizin for der.
Wi dey go small-small for many days and nor bi small wahala before wi fit rish Cnidus. Bikos di breeze nor make us fit go front again, wi kon drive small-small dey go Krete, wey dey opposite Salmone.
Di Spirit dey give odas di pawa to do mirakle and e make some pipol profets and some dey fit know wen God Spirit dey among us. Odas dey tok with difren-difren language and some among us go tell una wetin di tins wey dem dey tok, mean.
So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language.