For evry aria for di kingdom where dem for read di kommand, di Jew pipol for der go take holy day kon do party with happiness. In-short, many pipol kon turn to Jew, bikos dem dey fear di Jew dem naw.
I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple. Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz, keep my kovenant for en heart.”
God wey dey lead heaven sojas sey, “For dat time, ten strenjas go kom meet one Jew pesin sey, ‘Wi won share from yor blessings, bikos wi hear sey God dey with yu.’ ”
“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey travel go evriwhere just to win one pesin kon meet God and afta una don win am, una go kon make am bad well-well like devil pikin, pass as una bi!
Dis na di profets and tishas wey dey di church for Antiok: Banabas, Simeon wey dem dey koll Naija, Lucius wey kom from Sirene, Manaen (wey bi Herod di Tetrak friend from small pikin) and Saul.
Wen di meetin for di sinagog don finish, many Jew and Gentile pipol wey dey fear God kon follow Paul and Banabas, dey enkourage dem sey, make dem kontinue for di grace wey God give dem.
For der, e kon si one Jew wey dem dey koll Akwila, wey kom from Pontus and e just kom back from Italy with en wife Priscilla, bikos Klaudius orda sey make all Jew pipol komot from Rome. Paul go meet dem
For nite for di next day, Jesus kon stand near Paul tell am for vishon, “Make yu nor fear, bikos as yu don testify about mi for Jerusalem, na so yu go still do for Rome.”
Wen di brodas for Rome hear about us, dem waka until dem rish “Appius Forum” and di “Three Taverns” kom meet us. Wen Paul si dem, e tank God and di tin kon make en heart strong well-well.
Evribody like wetin di apostles tok, so dem kon choose one man wey en name na Stefen, bikos di Holy Spirit dey use am well-well. Di odas wey dem choose, na Filip, Prokorus, Nikanor, Timon, Parmenas and Nikolas wey kom from Antiok and e dey serve God like Jew pipol.
But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.
Rome pipol wey God love and koll make dem bi en own, na una I dey rite dis leta give. Make God awa Papa for heaven and Jesus awa Oga God give una grace and peace.