40 Bikos dem fit take all of us go kourt today sey wi dey rayot, bikos wi nor get any rizin for dis konfushon wey dey happen so.”
As Adonijah with all di pipol wey e invite dey finish dia party, dem kon hear di nois. Wen Joab hear di trumpet, e ask, “Wetin dey bring dat kind nois for di town?”
But dem sey, “Make wi nor do am wen di Feast don start, so dat pipol nor go make trobol.”
Many pipol don rite di story about di tins wey happen among us,
But if una wont anytin wey pass dis one, na kourt dem go for setol am.
Afta e tok finish, e kon sey make evribody go dia house.
Afta di wahala for Efesus, Paul send for di disciples and afta e enkourage dem, e tell dem bye-bye kon komot der go Masidonia.
As dem dey try to kill-am, news kon rish di kommanding offisa for di Roman soja wey dey guide di town sey, di whole Jerusalem don skata.
So nor bi yu bi dat Egypt man wey start wahala kon karry 4,000 men wey dem dey koll ‘Asassins’ go inside wildaness?”
Den Felix, wey bi sey e know di true story about di Way, pospone di kase kon sey, “Wen Lysias, di kommanding offisa kom, I go judge yor kase.”