4 Paul kon tell dem, “John baptize pipol wey turn from sin kom meet God with wota kon tell dem make dem bilive di pesin wey go kom afta am and na dat pesin, bi Jesus Christ.”
John kon bigin shaut sey, “Dis na di pesin wey I tell una about sey, ‘Di pesin wey go kom afta mi, big pass mi, bikos e dey before mi.’ ”
John ansa dem, “I dey baptize pipol with wota, but among una, one pesin dey wey una nor know.
E go kom afta mi. I nor rish to luz di rope wey dey en shoe.”
E kom bear witness for di lite, make evribody for fit get di shance to bilive wetin God tok thru en word.
John dey baptize with wota, but e nor go tey wen God go baptize una with en Holy Spirit (wey go kontrol una life forever).”
So I kon remember wetin di Oga God don use en own mout tell us before sey, ‘John use wota baptize pipol, but God go baptize una with di Holy Spirit.’