31 Even some for di oga dem wey bi en friend, send message go meet am sey, make e nor enter di stadium.
Wen pesin make belle sweet God, even en enemies go like bi en friend.
One man wey bi leper kom meet Jesus, knee down for en front dey beg am sey, “If yu wont, yu go fit make mi well.”
Dem pass thru Frigia and Galatian aria, bikos di Holy Spirit warn dem sey make dem nor prish di message for Asia.
Dis tin kontinue for two years until evribody wey dey stay for Asia aria, weda na Jew or Greek, hear God word.
Di whole town kon dey shake with nois and all di pipol rush go di stadium dey drag Gaius and Aristakus and di Masidonia pipol wey dey escort Paul.
But wen Paul one enter di stadium, di disciples nor allow am.
Na so all di pipol dey shaut anyhow and konfushon kon full evriwhere, many pipol wey gada dey shaut, nor even know why dem gada.
Wen wi hear wetin e tok, wi and di pipol wey dey der kon beg Paul sey make e nor go Jerusalem.