One day, as wi dey go di place where dem for dey pray, one slave girl wey get spirit wey dey make am si vishon, kon si us. Di girl oga dey use am make plenty money, anytime e tell pipol wetin go happen.
But wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem take dey make money don go, dem seize Paul and Silas kon drag dem go meet di town oga dem for di market centre.
Di man kon gada all di pipol wey dey mold, with oda men wey dey do dat kind work, den e tell dem, “My pipol, una know sey na dis business wi take dey chop.