20 So God word kon dey grow more-more and dem kon dey win many souls.
Na so e bi too with di word wey I dey tok; e go must do wetin I plan for am. E go must do evritin wey I send am make e kom do.
But God word kontinue to dey spread.
So wen di Roman offisa si wetin happen, e kon bilive, bikos e sopraiz well-well for wetin dem tish about Jesus Christ.
Dis tin kontinue for two years until evribody wey dey stay for Asia aria, weda na Jew or Greek, hear God word.
Na so God word start to spread and di disciples wey dey Jerusalem kon plenty well-well. And many priests kon bilive Jesus Christ.
Finally, my brodas and sistas, make una pray for us, so dat Christ message go kontinue to spread kon get glory just as e really get among una.