12 even handkachief and klot wey dem take tosh Paul body, dey heal sick pipol and drive evil spirit from pipol body, wen dem use am tosh dem.
So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.
Dis signs go follow pipol wey bilive: With my name, dem go drive demon komot from pipol body; dem go speak new language wey dem nor learn;
sotey dem even dey karry pipol wey nor well put for bed and mat for road, so dat as Pita dey pass, en shadow go heal dem.