Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 18:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Wen dem oppoz and curse am, e shake en dress kon sey, “Make una blood dey una head, bikos I nor do any bad tin and from today go, I go-go prish for Gentile pipol!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 18:6
37 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

den David tell di dead man, “Na yu use yor mout take kill yorsef: Yu kondemn yorsef wen yu sey yu kill di pesin wey God choose as king.”


Dia blood go dey for Joab and en shidren-shidren head forever. But God go make David and shidren-shidren prosper for en throne forever.”


I pul di garment wey I wear kon shake am. Den I sey, “Na so God go take shake any of una wey nor keep en promise. E go distroy una house and evritin wey una get and nor-tin go remain for una.” Evribody wey dey der kon sey, “Amen!” Den dem kon praiz God. And di ofisas and doz wey get money, do wetin dem promise.


and dey borrow pipol money to make gain. E go fit live? No! E nor go live. E don do all dis bad tins, so e must die and e go blame ensef for en own deat.


If anybody hear and nor gri listin to am and di enemies kon kill-am, na-im kause en deat by ensef.


But if di wosh-man si di enemies dey kom and e nor ring di bell, di enemies go kill di pipol bikos of dia sin, but I go whole di wosh-man for dia deat bikos e nor warn dem.’


“ ‘If anybody curse en papa and mama, dem must kill-am and en blood go dey en own head, bikos e curse en papa and mama.


If di pipol nor welkom or listin to una message, make una shake dia san komot from una leg as una dey leave dat house or town.


Dem ansa Jesus, “E go distroy doz evil pipol! Den e go hire di farm give oda farmers wey go gi-am wetin bi en own, wen harvest time rish.”


“Na dis make mi tell una sey, ‘Dem go take God Kingdom from una and dem go gi-am to pipol wey go bear di kind fruit wey E wont.’


So di savants go di strits kon gada all di pipol wey dem si, both bad and good, kom di marriage and di hall kon full.


Di pipol ansa, “Make en blood dey awa head and awa shidren own!”


Many pipol from east and west go kom follow Abraham, Isaak and Jakob chop inside God Kingdom.


Anywhere wey dem nor welkom una, make una shake di san from una leg as una dey komot and dis go bi witness against dem.”


So wen dem don shake di land san-san wey dey dia leg komot, dem kon go Ikonium.


I ponish dem many times for all di sinagog and I try to force dem make dem curse God. Bikos dat time, I dey vex for dem well-well, I even travel go oda towns go sofa dem, bikos of wetin dem bilive.


but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.


“So make una know sey, dis salvashon wey God bring, dem don karry am go meet Gentile pipol, bikos dem go asept am!”


Abi na only Jew pipol God dey dia side? E nor dey Gentile pipol side too? True-true, God dey Gentile pipol side.


Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.


E must dey gentol as e dey korrect pipol wey dey oppoz en prishin and God fit let dis pipol turn from sin kom meet am, so dat dem go know di trut.


If dem curse una bikos of Christ, God don bless una bi dat, bikos God Spirit wey get glory, rest on-top una life.


Naw, doz unbilivers dey sopraiz and curse una, bikos una nor dey follow dem do bad and wiked tins again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ