Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 18:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 E get one Jew man, en name na Apollos and e from Alexandria go Efesus. Apollos sabi tok and e know di Bible well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 18:24
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

From Atazazes wey bi king of all kings to Priest Ezra wey know God for heaven law well-well: I greet yu.


Ezra go skool and e know di law wey di Oga wey bi Israel God give Moses, well-well. Bikos God dey with Ezra, di king dey gi-am evritin wey e ask for.


Den Moses tell God, “My Oga God, Yu know sey I nor sabi tok well since dem born mi kon rish naw wey Yu dey tok to mi, yor savant.”


sojas oga, dia pipol, advisers and doz wey sabi do majik.


Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”


Jesus ask dem, “Wish tins?” Dem ansa, “Di tins about Jesus wey kom from Nazaret, one man wey wetin e dey tok and do show sey en na God profet


Wen dem rish Efesus, Paul leave Priscilla and Akwila for der, but en ensef enter di sinagog go follow di Jew pipol tok.


but e tell dem bye-bye kon sey, “If God wont, I go kom again kon si una.” Den e enter ship from Efesus


bikos e nor gri with wetin di Jew pipol dey tok for publik and e show dem from di Bible sey na Jesus Christ, bi di Mezaya.


For di same time wen Apollos dey Korint, Paul travel pass inside town until e rish Efesus. For der, e meet some disciples


For der, di soja kommander kon si one ship wey kom from Alexandria dey drive go Italy and e kon put us for inside.


But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.


So dem tish Moses all di wise tins wey Egypt pipol dey do and e kon get wisdom for how e dey tok and wetin e dey do.


Wetin I hear bi sey, some of una dey sey, “Na Paul side I dey” odas sey, “Na Apollos side I dey” some still sey, “Na Pita side I dey” or “Na Christ side I dey.”


I don try well-well make Apollos for fit follow oda bilivers kom visit una, e nor won kom naw, but e go kom leta.


My friends, I don use mysef and Apollos as ezample for una, so dat thru us, una go know wetin e mean to obey di law. I nor wont make una dey sey one of us betta pass di oda pesin.


bikos some pipol dey sey, “En letas dey heavy and get pawa well-well, but if yu si am for groun, e nor get pawa and e nor even fit tok well.”


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


Make yu do evritin wey yu fit do to help Zenas, wey bi lawyer and Apollos for dia journey and make sure sey dem get evritin wey dem nid.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ