11 So Paul stay der for one year and six monts dey tish di pipol God word.
Di apostles stay der tey well-well and dem tok with boldness about God, wey show sey dia message about en goodness na true, bikos E kon give dem pawa to do many mirakles and wonders.
I dey for yor side and nobody go fit do yu anytin, bikos I get plenty pipol for dis town.”
Wen Gallio dey rule for Akaia, Jew pipol join togeda attack Paul kon karry am go di judgement seat.
Dis tin kontinue for two years until evribody wey dey stay for Asia aria, weda na Jew or Greek, hear God word.
So make una shine una eye and remember sey, for day and nite for three years, I nor stop to dey kry, as I dey warn una.