So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.
But nor-tin wey pipol use against una, go fit distroy una; una go ovakom evribody wey dey akuiz una. Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy and I go defend and make dem win.” Na so God tok!
But e tell mi, “Di grace wey I give yu strong rish, bikos my pawa dey show wen yu dey weak.” So, I go boast well-well about how I nor dey strong, so dat Christ pawa go dey show for my body.
I dey tok again, so dat yu go dey strong kon get heart! Make yu nor fear or shake, bikos mi wey bi di Oga yor God, I dey with yu for evritin wey yu dey do.”
As long as di leaders wey God give di pipol dey alive, E help and diliver dem from dia enemies. God sorry for dem well-well wen dem kry to am with pain, bikos of wetin dia enemies dey do dem.