Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 17:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 Bikos na inside am wi dey live, waka, get life and some of una wey dey rite poem tok sey, ‘Wisef na God pikin.’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 17:28
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

bikos na God hand dey hold di eart and evribody dey alive bikos of en pawa.


bikos na Yu bi di wota wey dey give life; di lite wey make us dey si.


Awa life dey en hand and E nor let us fall.


So King Zedekaya promise mi for sekret sey, “I swear with God wey dey alive and wey give us life sey, I nor go kill or give yu to di men wey won kill yu.”


Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways!


Awa God nor bi God for dead pipol, but na God wey dey alive, bikos for God eye, evribody dey alive.”


Kenan na Enosh pikin, wey bi Seth pikin, wey bi Adam pikin and na God kreate Adam.


Jesus ansa am, “Na mi bi di resureshon and na mi dey give life. Anybody wey bilive mi go get life even if e don die


Bikos as di Papa get life for inside am, na so e give en pikin life too.


Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”


Christ dey before evritin and bikos e dey, evritin still dey where dem dey.


Even one among dia own profets sey, “Krete pipol dey always tok lie, dem bi wiked animals and lazy pipol wey get long-trot.”


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


If awa papa for eart ponish us and wi dey respet dem, e nor good make God ponish us, so dat awa life go betta?


True-true, Jesus make pipol dey holy, so en and di pipol wey e make holy, na God kreate dem. Na dis make am nor dey shame to koll dem en brodas and sistas.


Anybody wey dey porshu and won kill yu, di Oga yor God wey dey heaven go protet yor life and nor-tin go happen to yu. But e go skata and kill yor enemies, wons and for all.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ