So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.
“Na with my mighty pawa and great strent I take kreate di eart, di pipol and di animals wey dey inside and I don give dis pawa to pipol wey I like gi-am to.
Di two kings go sidan chop for di same tabol, even doh dem get bad belle for each oda; dem go dey deceive each oda. Dem nor go get wetin dem won get, bikos di time neva rish.
Nor bi di same papa all of us get? Nor bi di same God kreate all of us? Den why wi dey break awa promise wey wi make to each oda kon hate di kovenant wey God make with awa grand-grand papa dem?