Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 17:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 So some wise men wey dey learn Epikurean and Stoik kon dey tok with am and some sey, “Wetin dis mumu and toku-toku tink sey e know wey e won tell us?” Some still sey, “E bi like sey e dey prish about some gods from anoda tribe.” (Dem tok so, bikos e dey prish di Good News about Jesus Christ and en resureshon.)

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 17:18
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu nor try to tok sense give foolish pesin, bikos e nor go value am.


Pesin wey foolish well-well, betta pass pesin wey tink sey e wise, but e nor get sense.


Wen Jesus, Pita, James and John kom meet di oda disciples, dem si many pipol and di law tishas gada, dey argue with dem.


Wen Jesus komot from der, di pipol wey know di law well-well and di Farisee pipol kon dey vex, so from dat time, dem kon bigin ask Jesus yeye kweshon about many tins


sey Christ sofa and e go bi di first to raiz from deat, so dat e go show di lite to awa pipol and even Gentile pipol.”


Dem dey vex, bikos Pita and John dey tish di pipol sey, na only thru Jesus Christ, pipol go fit wake-up from deat.


So evriday for di temple kompond and from house to house, dem kontinue to dey tish and prish di Good News sey, “Na Jesus Christ bi di Mezaya.”


But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.


Even doh dem tink sey dem wise, dem bi fools;


Make una nor let anybody deceive una. If anybody tink sey e get sense for dis life, make e turn to fool, so dat e go really get sense.


Bikos of Christ, pipol dey si us as fools, but God don make us wise. Wi weak and dem hate us, but dem dey respet una wey dey strong.


Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ