Una go komot from Babilon with joy and dem go lead una komot from di town with peace. Di mountins and hills go dey sing and di trees go dey shaut with happiness.
Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
Afta en and en family don baptize, e kon beg us sey, “If una don asept mi as pesin wey bilive Christ, make una kon stay for my house.” So e beg us until wi gri.