28 But Paul shaut, “Make yu nor kill yorsef, all of us still dey for here!”
I dey mourn for dem, just as I go do for my broda or friend. I dey bow with sorrow like sey I dey mourn for my mama.
if I sin against my friend or ponish my enemies wen dem nor do anytin against mi,
Make una nor kill.
But doz wey nor find mi, dey wound demsef and anybody wey hate mi, love to die.”
Make yu nor dey too wiked or bihave like fool, if not, yu fit die before yor time!
Make una nor revensh anybody or kontinue to dey hate di pesin, but make una love una neighbour as una love unasef. Na mi bi God.
But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’,
But Jesus shaut for am make e stop, den tosh di man ear kon heal am.
(Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.
Wen di warda wake-up kon si sey all di doors for di prison open, e bring en swod kom out, won kon kill ensef, bikos e tink sey all di prisonas don run.
Naim di warda sey make dem bring lite and e rush enter inside di prison kon fall for Paul and Silas front dey shake.
Make una dey sure sey nobody pay bad for bad, but for evritime, make una always dey do good for each oda and for evribody.