Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 16:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 One day, as wi dey go di place where dem for dey pray, one slave girl wey get spirit wey dey make am si vishon, kon si us. Di girl oga dey use am make plenty money, anytime e tell pipol wetin go happen.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 16:16
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E dey sakrifice en sons and dey do majik. E dig one pit where dem for dey koll dead body spirit kom out kon choose majik men make dem dey look am. Di bad-bad tins wey e do many well-well for God eye, so God kon dey vex.


Saul die bikos e nor respet or obey God kommand. E go meet spirit make e help am


But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.”


Make una nor go take advise from pipol wey dey serve dead pipol spirit. If una do am, una go dey unklean. Na mi bi Oga una God.


“ ‘Man or woman wey dey woship dead body spirit, dem must kill dem. Dem must stone dem die and anybody wey do dis tin go sofa di ponishment for en sin.’ ”


“ ‘Di pesin wey dey go meet dead body spirit for advise, I go turn against am kon remove am from my pipol.


Wen Sabat Day rish, wi komot from di town go di wotaside, where wi tink sey wi go si where dem for dey pray, naim wi sidan kon start to dey tok to di wimen wey gada for der.


E kontinue to dey shaut like dis for many days. So di tin vex Paul well-well, naim e turn face di girl kon tell di spirit, “I kommand yu with Jesus Christ name, komot for dis girl body!” At wons, di spirit komot from di girl body.


But wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem take dey make money don go, dem seize Paul and Silas kon drag dem go meet di town oga dem for di market centre.


E get one man, en name na Demetrius and e dey mold silva image. Na dis man mold Artemis shrine and dey help pipol wey dey mold, make plenty money.


to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol;


Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.


Just as Jannes and Jambres oppoz Moses; na so too, dis pipol wey dia mind block and nor get faith, dey oppoz di trut.


and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.


Naw, Samuel don die and evribody for Israel dey mourn. Dem beri am for en town for Rama. For dis time, Saul don porshu all di majik pipol and doz wey dey si vishon komot di town.


So Saul kommand en savants, “Make una go find any woman wey dey do majik kom, so dat I go-go ask am wetin go happen.” En savant ansa, “E get one majik woman for Endor.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ