Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 16:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 E get one woman wey dey listin to us, en name na Lydia and e kom from Tiatira. E dey fear God well-well and dey sell purpol klot. God open en heart to bilive evritin wey Paul tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 16:14
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.


My love try to open di door from outside thru di hole and I kon dey feel for am.


God don make mi undastand well-well and I neva tok anyhow or turn from am.


Den e open dia mind so dat dem go fit undastand God word


Some Greek pipol go woship God for di feast for Jerusalem.


E dey holy and en and en family dey woship God. E dey help di pipol well-well and dey pray to God evritime.


God pawa dey with dem and many pipol wey bilive kon bigin dey follow Jesus Christ.


Wen di meetin for di sinagog don finish, many Jew and Gentile pipol wey dey fear God kon follow Paul and Banabas, dey enkourage dem sey, make dem kontinue for di grace wey God give dem.


But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria.


Wen dem don komot for prison, dem enter Lydia house and wen dem si di brodas, dem enkourage dem before dem leave di town.


Den Paul komot for di sinagog go Titus Justus house; di man na Gentile wey dey woship God and en house dey near di sinagog.


So Filip kon dey waka dey go where di angel tell am. As e dey go, e meet one uncle wey kom from Ethiopia, e bi offisa for Kandace wey bi Ethiopia kween and na-im dey keep dia money. E kon woship God for Jerusalem


Derfor, evritin dey for God hand, nor bi by wetin pipol won do.


bikos na God dey work inside una and una go fit do good tins kon get di pawa wey go make una happy.


“Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”


Listin! I stand for di door dey nok! If anybody hear my vois, kon open di door, I go enter go meet am, kon follow am chop and e go chop with mi too.


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Filadelfia: ‘Di Pesin wey dey holy and true, wey whole David key; wen dis pesin open door, nobody go fit klose am and wen e klose door, nobody go fit open am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ