31 Bikos of wetin dem rite put for di leta, all di pipol happy wen dem read am out.
Some men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, “Unless dem sekonsaiz una di way Moses tok for di law, una nor go fit get salvashon.”
So why una won kon try God? Load wey wi and awa grand-grand papa dem nor fit karry, why una dey put am for dis disciples head?
So wen dem don send dem go, dem kon go Antiok and afta dem gada evribody, dem kon give dem di leta.
But Judas and Silas, wey bi profet, enkourage di pipol and wetin dem tok kon make di pipol heart strong.
So di pipol for di church dey strong more-more for faith and dem kon dey plenty evriday.
Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free.
Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.