Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 15:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 15:20
47 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Jakob tell en hold family and doz wey dey with am sey, “Make una skata all di oda gods wey dey with una. Make una go wosh unasef kon shange una klot.


But make una nor chop meat wen en blood still dey inside am.


So make una nor use silva or gold take make any oda god join mi.


Naw, make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘Una dey chop meat with dia blood; dey woship juju and dey kill pipol. So wetin make una tink sey na una get di land?


But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”


But Daniel kon decide sey e nor go chop di sweet food and wine wey dem dey serve for di king palis, bikos e nor won dey unklean. So e beg di pesin wey dey lead dem sey, en nor won chop di royal food or drink di wine.


“ ‘Make nobody sleep with en family memba, bikos na mi bi God.


“ ‘Una must nor chop anytin wey still get blood for inside. Una must nor do majik or serve juju.


“ ‘Make una nor ever chop any fat or blood and Israel pipol must obey dis law from one generashon go rish anoda.’ ”


Dis wimen invite di pipol kom dia juju festival; den di pipol chop and woship dia juju.


‘Wi advise sey make una forbid meat and blood wey dem don sakrifice give juju and any animal wey una kill wey en blood nor tosh groun. And make una nor sleep with who una nor marry.’ If una forbid all dis tins, una go do well!”


But for Gentile pipol wey don bilive, wi don rite leta go give dem sey, make dem forbid meat wey dem sakrifice give juju; animal wey dem kill and e blood nor tosh groun and make dem nor sleep with who dem nor marry.”


But naw, I dey rite to una sey, pipol wey sey dem bi Christians and dem dey do bad tins, make una nor follow dem make friend. Make una nor even chop with dat kind pesin.


Una still dey sey, “Food dey good for awa body and awa body nid food.” But I dey tell una, “God go distroy di two of dem.” So make wi nor use awa body take do yeye tins.


Make una nor live ashawo life. Evry oda sin wey man dey kommit na for outside en body, but di pesin wey dey do ashawo, dey sin against en own body.


Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;


But make una nor for dey do ashawo, e betta make una marry.


For di leta wey una rite, una ask mi about juju food. And all of us know sometin koncerning dis matter. But if wetin wi know, dey make us dey proud, den bikos of love, wi suppose help one anoda.


I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.


Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol;


To dey sleep with pesin wey yu nor marry; dey do tins wey nor dey pure and get long-trot, make una nor allow dis tins dey among una, bikos dem nor good for God pipol.


But una must nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.


Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.


But make una nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.


So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju.


Na wetin God wont bi dis: Make una dey holy; komot hand for bad tins; nor sleep with who nor bi yor wife or husband.


Make una make sure sey nobody dey do bad tins or nor dey fear God, just like Esau wey sell en rite as first-born, bikos of food.


Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.


Di time wey una dey bihave like unbilivers, don pass. Dat time una live bad life; dey do bad tins; dey drink; dey do anyhow and serve juju.


E hold one small book wey open for en hand and e stand with en rite leg on-top sea kon put en left leg for land.


Den di vois from heaven tell mi again, “Di angel wey stand for wota and land, make yu go take di book wey dey en hand.”


But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.


But dis na wetin I get against yu: yu allow dat woman, Jezebel, make e dey do wetin e like. Dat woman wey koll ensef profet and di tins wey e dey tish dey make my savants sin, bikos dem dey sleep with who nor bi dia husband or wife and dem dey chop juju food.


But di pipol wey dis tins nor kill, nor still gri turn from sin kom meet God wey go save dem. Dem kontinue to serve demon and juju wey dem make with gold, silva, bronze, stone and wood. Dis juju nor dey si, hear or waka.


So di sojas kon rush with honga, bigin kill both sheep, kattle and melu. Dem kill dem kon chop di animal, di blood and evritin.


So dem kon tell Saul wetin dey happen, “Si, di sojas don sin against God as dem dey chop evritin plus blood sef.” Saul kon sey, “All of una don break di kovenant! So make una roll one big stone kom here.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ