10 So why una won kon try God? Load wey wi and awa grand-grand papa dem nor fit karry, why una dey put am for dis disciples head?
So dem komplain give Moses, “Make yu give us wota drink!” Moses ansa dem, “Wetin make una dey kworel with mi? Why una dey test God?”
Den King Ahaz ansa, “I nor go ask for sign and I nor go fit tempt my God.”
Dem dey put heavy load for pipol shoulder and dem nor ready to help dem.
Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor try God wey bi yor Oga God.’ ”
So Pita tell am, “Wetin make yu and yor husband decide to try God Spirit like dis? Look! Na di pipol wey go beri yor husband dey kom so and dem go karry yu go beri too!”
But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again?
Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free.
Na for di wildaness una papa for test and try mi for forty years, even doh dem si di mirakles wey I do.
Dis na sign make wi for fit undastand sey: Di gifts and sakrifice wey di priests dey offa for God pipol, nor fit make dia mind klean.