Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 15:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Some men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, “Unless dem sekonsaiz una di way Moses tok for di law, una nor go fit get salvashon.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 15:1
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di eight day, dem go sekonsaiz di pikin.


Na true sey Moses tell una to sekonsaiz una son, (nor bi Moses start am, na from Abraham time e start) and una dey sekonsaiz una son for Sabat Day.


Di pipol wey dey pray, plenty rish one hundred and twenty. So Pita stand up for di pipol front kon sey,


So di apostles, eldas and di whole church kon gri sey dem go send some men follow Paul and Banabas go Antiok. Den choose Judas, wey dem dey koll Barsabas and Silas and dem bi leaders among di brodas.


Na wetin dem rite for di leta, bi dis, “From di apostles and eldas wey bi una brodas, to all di brodas and sistas wey bi Gentile wey dey Antiok, Siria and Silisia. Wi greet una o-o!


Wi hear sey some pipol kom meet una sey dem kom from us, even doh wi nor send dem. Dem dey konfuse and tell una wetin go disturb una mind.


So di church send dem go and as dem dey go, dem pass Foenicia and Samaria kon tell pipol wey dem meet for der how Gentile pipol take turn from dia sin kom meet God and di story make all di brodas wey hear am, happy well-well.


But Judas and Silas, wey bi profet, enkourage di pipol and wetin dem tok kon make di pipol heart strong.


But some Farisee wey don bilive Christ stand up kon sey, “E good make wi tell Gentile pipol make dem sekonsaiz and do evritin wey Moses Law tok.”


Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey praiz God. Den, dem tell am, “Yu si, awa broda, many Jew don bilive and dem still dey obey di law!


Wi hear wen e dey tok sey Jesus Christ wey kom from Nazaret go skata dis place and e go shange all di tradishon wey Moses give us.”


Afta fourteen years, I kon go back to Jerusalem with Banabas and Titus.


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


Pipol wey won show sey dem good, dey try to force una to sekonsaiz. Dem dey do so, so dat dem nor go sofa, bikos of Christ cross.


So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una.


Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ