Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 14:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Di Gentile and di Jew pipol (with di oga dem wey dey rule dem) kon dey try to sofa and stone di disciples,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 14:5
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

All of dem gada togeda and dem dey plan against Yu.


But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’,


Make una bless doz wey curse una and pray for doz wey dey trit una anyhow.


But wen di Jew pipol si as di pipol plenty rish, jealousy kon full dia mind, so dem start to oppoz wetin Paul dey tok kon dey curse am.


But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria.


But afta some Jew pipol wey kom from Antiok and Ikonium don win di pipol mind, dem kon stone Paul, drag am komot from di town, bikos dem tink sey e don die.


But di Jew pipol wey nor gri bilive, gada di Gentile pipol kon spoil dia mind against Paul and Banabas.


But di pipol wey dey di town kon divide; some dey di Jew side and some dey di apostle side.


But di Jew pipol dey jealous, so dem kon gada aria boys wey dey waka about for market, take form gang to skata di town. Dem attack Jason house, bikos dem tink sey Paul and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon take dem go di town hall.


I don travel many times wey I enter trobol for wota; for tif hand, even for my kountry pipol and Gentile pipol hand; both for inside town; for wildaness and from pipol wey dey pritend sey dem bi awa brodas.


My brodas and sistas, na di same tin happen to God church for Judea and una wey bilive Christ for der don still sofa pain from una kountry-men wey bi Jew pipol.


Dem even try to stop us, so dat wi nor go prish di message wey go give salvashon to Gentile pipol. As dem dey do so, dia sins dey plenty more-more. But naw, God vexnashon with ponishment dey kom meet dem.


Before wi kom meet una for Tesalonika, dem sofa and trit us anyhow for Filippi and many pipol nor wont make wi tok, but awa God give us pawa to prish en Good News.


Yu know di wahala and sofa wey happen to mi for Antiok, Ikonium and for Lystra. I bear all dis wahala and Christ save mi from dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ