Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 14:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 But di pipol wey dey di town kon divide; some dey di Jew side and some dey di apostle side.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 14:4
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos boy pikin go rijet en papa and na so too girl pikin go rijet en mama. Wife go sey e nor know en husband mama and una enemy, go bi una family memba!


Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept.


As dem dey fast and woship God, di Holy Spirit kon tell dem, “Make una separate Banabas and Saul for di work wey I wont make dem do.”


But wen di Jew pipol si as di pipol plenty rish, jealousy kon full dia mind, so dem start to oppoz wetin Paul dey tok kon dey curse am.


But di Jew pipol tok bad tins about Paul and Banabas give all di big wimen wey dey fear God and di big-big men for di town, so dem sofa dem and drive dem komot from di aria.


Wen Banabas and Paul hear about di tin wey di pipol won do, dem shaut, tear dia klot kon run go meet di pipol sey,


But afta some Jew pipol wey kom from Antiok and Ikonium don win di pipol mind, dem kon stone Paul, drag am komot from di town, bikos dem tink sey e don die.


But di Jew pipol wey nor gri bilive, gada di Gentile pipol kon spoil dia mind against Paul and Banabas.


Di Gentile and di Jew pipol (with di oga dem wey dey rule dem) kon dey try to sofa and stone di disciples,


But wen some sturbon pipol nor gri bilive, dem kon dey spoil Jesus Christ name for all di pipol front, so Paul with en disciples kon leave dem. Paul dey take en disciples follow body evriday, go tish for Tirannus Hall.


Some among dem bilive wetin e tok, but some nor bilive.


abi wi nor get rite to marry biliver for Christ?


My brodas and sistas, na di same tin happen to God church for Judea and una wey bilive Christ for der don still sofa pain from una kountry-men wey bi Jew pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ