7 e dey with Sergius Paulus, one Roman offisa wey know book well-well. Di offisa invite Banabas and Saul kom en house, bikos e won hear God word.
Doz wey nor get sense dey bilive evritin wey pipol tell dem! But wise man dey wosh en step.
Doz wey nor get sense dey wear foolishness as klot for body; but na wisdom bi wise pipol kap.
Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.
Wise pesin dey always look for knowledge and en mind dey find wisdom.
Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.
So wen di Roman offisa si wetin happen, e kon bilive, bikos e sopraiz well-well for wetin dem tish about Jesus Christ.
But “Elymas” wey bi magician, (bikos na wetin en name mean bi dat) kon dey oppoz dem, so dat di Roman offisa nor go bilive wetin dem dey prish.
Wen Gallio dey rule for Akaia, Jew pipol join togeda attack Paul kon karry am go di judgement seat.
If Demetrius and di pipol wey dey with am get any komplain against anybody, kourt dey and judge dem dey der too. So make dem take dia kase go der.
Make una test evritin kon dey do wetin good.