“God ask am, ‘How yu wont take deceive am?’ “Di spirit ansa, ‘I go make all di profets lie for Ahab.’ “So God tell am, ‘Make yu go deceive am, bikos e go hear yu.’ ”
But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.
Dem kon go Jeriko. As Jesus and en disciples with plenty pipol dey komot for der, Bartimaeus wey bi Timaeus pikin, one beggar wey blind, sidan for road dey beg.
My friends, make una nor bilive evribody wey sey na God Spirit dey tok thru am. Una must test am to know weda na God Spirit e really get. Bikos many fake profets dey for dis world.
So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.