52 So di disciples kon dey happy and di Holy Spirit full dia life.
make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”
So di disciples, evribody akordin to how e fit do rish, kon sey dem go send money go give di brodas wey dey Judea.
Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.
Dem dey stay togeda evriday like one big family. Dem dey gada go di temple togeda and dem dey go from house to house, dey chop togeda with happiness.
Wen dem pray finish, di place wey dem gada put kon dey shake. Di Holy Spirit enter all of dem and dem kon dey prish God Word with pawa.
So di apostles komot from der dey happy well-well sey God don give dem di shance to sofa, bikos of Jesus Christ.
Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol.
I pray make God wey dey give hope, bless una with joy and peace bikos of una faith. So make di Holy Spirit pawa full una body with faith.
Wi still dey happy inside di wahala wey wi dey face, bikos wi know sey trobol go make us endure,
even wen dia sofa strong well-well; dem still dey happy and wen dem nor get money at-all; dem still dey fine money give us.
But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,
So, una kon bigin do as wi and Christ dey do; even doh una sofa well-well, una receive di message with joy wey di Holy Spirit dey give.
My brodas and sistas, make una dey happy wen una dey face temptashon,
Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una.