42 As Paul and Banabas dey komot, di pipol kon dey beg dem make dem still kon tok about all dis tins for di next Sabat Day.
Even if I send yu go meet pipol wey dey tok wetin yu nor undastand, dem go still listin to yu.
“E nor go betta for Korazin and Betsaida pipol! If to sey di mirakles wey dem do among una happen for Tyre and Sidon, dem for don turn from dia sin kom meet God, kon karry ashes put for head and wear tear-tear klot,
So many pipol wey bi first naw, go bi last and doz wey bi last, go bi first.”
As Jesus dey tok dis tins, one oga kom knee down for en front sey, “My dota just die, make yu kom tosh am and e go wake-up.”
So, I kon send pipol go koll yu and yu do well as yu kom. Na wi bi dis for God present, wi ready to hear wetin E sey make yu tell us.”
Wen dem komot for Perga, dem rish Antiok for Pisidia for Sabat Day kon enter di sinagog go sidan.
“So make una know sey, dis salvashon wey God bring, dem don karry am go meet Gentile pipol, bikos dem go asept am!”