So I go still do tins wey go dey sopraiz dem: tins wey dem nor go undastand. Wise men nor go get anytin to tok; doz wey get sense nor go fit esplain wetin dey happen.”
God ansa, “Make yu look di nashons well and wetin yu go si, go sopraiz yu! I go do sometin naw wey yu still dey alive and even wen pesin tell yu, yu nor go bilive.
But who go fit bear di day wen E go kom? Who go fit survive wen E go appear? Bikos E go bi like strong soap wey dey spoil klot and like fire wey dey melt iron.
Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.
Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”
“God leave dem make dem woship stars to make wetin Profet Amos tok, happen sey, ‘Israel pipol, una tink sey na mi una dey serve wen una dey sakrifice animal for inside wildaness for forty years?’
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?