33 E don do wetin E promise us and dia shidren, wen E raiz Jesus Christ, as dem rite am for Psalms sey, ‘Yu bi my Pikin and today, I don bi yor Papa.’
Den di king sey, “I go tell una wetin God kommand. God tell mi sey: ‘Yu bi my pikin! Today, I don bi yor papa!
So wen Jesus don wake-up from deat, en disciples kon remember sey, e tok so before. Den dem kon bilive wetin dem rite for God word and wetin Jesus tell dem.
But God raiz am from deat
But bikos E don raiz Jesus Christ from deat make e nor for rotin, God kon sey: ‘I go give yu di holy promise wey una fit trust, wey I promise David.’
but di pesin wey God raiz-up, nor rotin.
But God kon raiz am up afta E don gi-am pawa to win deat, bikos deat nor get pawa to hold am.
God don raiz dis Jesus Christ up and evribody si am.
At wons, e kon start to dey prish for di sinagog sey Jesus Christ na God Pikin.
Christ nor praiz ensef wen e bikom High Priest, but na God praiz am wen E sey, “Yu bi my Pikin! Today, I don bikom yor Papa.”