Bikos of yor love, Yu dey patient with dem for many years. Yu send yor Spirit wey warn dem thru di profets. But yet, dem nor gri listin! So Yu allow oda nashons attack dem again.
non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.
Make una remember and nor ever forget how una make di Oga una God vex for di wildaness. From di day wey una komot Egypt kon rish naw, una dey always sin against God.