Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 13:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Na from Israel pipol God choose awa grand-grand papa dem and E kon make dem great for di time wey dem dey Egypt as strenja and E karry dem komot from Egypt with en own hand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 13:17
42 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.


For dat day, Oga God take Israel pipol komot from Egypt akordin to der tribe.


“Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.


Dis matter go bi like sign for una hand and fore head, so dat una go remember as di Oga God take karry us komot from Egypt with en mighty pawa.”


God make Fero heart strong well-well, so e kon porshu Israel pipol. Naw Israel pipol just komot Egypt with betta mind.


Naw, I know sey God big pass all di gods, bikos en pipol don dey save from Egypt pipol pawa; Egypt pipol wey wiked and like yanga well-well.”


God sey, “Make una listin, Israel pipol wey bi my savant and Jakob shidren-shidren wey I choose.”


Na mi still bring una kom out from Egypt; lead una pass desert for forty years, den give una Amor pipol land.


Na mi bring and save una from Egypt where una for bi slave. I send Moses, Aaron and Miriam kom help una.


Wen una grand-grand papa dem go Egypt, dem bi only seventy. But naw, di Oga una God don make una plenty like di stars for sky!


Bikos una dey holy to di Oga una God, na-im make am choose una as en pipol wey E love pass among evry oda tin for dis world.


Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today.


Or God don ever try to diliver one kountry from anoda kountry with judgement, signs, wonders, war, strent, pawa or any oda tin wey dey make pesin fear like di ones wey God do for Egypt for una own eyes?


Bikos E love una grand-grand papa, E kon choose to bless dia shidren-shidren and na en own hand E take komot una from Egypt with all di wonders wey E do.


di betta judgement wey una si, di signs and wonders wey God do; en strent and pawa wey E use take-take us komot der and na so di Oga una God go do to all dis pipol wey una dey fear.


Una nor dey enter and stay dis land, bikos una dey good or get sense. Di Oga una God go porshu dis pipol komot for una, bikos of di wikedness wey dem dey do and to fulfil di promise wey E make with una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


Dis one sirious well-well! Na who go save us from dis big-big gods? Dis na di gods wey kill Egypt pipol with difren diziz for di desert!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ