I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”
Dis na di bad part about evritin wey dey happen for dis world: na di same tin go happen to evribody. Plus dis sef, na wikedness full human being mind and na wetin dem like dem dey do, den one day, dem go die.
So make una nor sey God message na wahala, bikos if anybody tok like dat, den di message go bi wahala to am. Di pipol don shange dia God; di Almighty God wey dey alive, dem don shange en word.
Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.
“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.
But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom?
“Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una don seize di key wey dey make pipol know di trut! Since una nor gri enter, una nor wont make oda pipol enter too.”
John kon sey, “Na mi bi dat vois wey dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make di road wey pipol go pass go meet God strait well-well’, as Profet Isaya tok before.”
Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.
So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.
But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.