For di mont wey dem dey koll Abib, una go celebrate di bread wey nor get yist feast and for seven days, una go dey chop bread wey nor get yist, just as I kommand una wen una komot from Egypt. Nobody go kom meet mi with empty hand.
For di day wen dem start di Feast for di Bread wey nor get yist, di disciples kom meet Jesus Christ tell am, “Tell us where yu for won chop di Passova Food, so dat wi go-go prepare di place.”
I tell yu true word, wen yu dey small, yu dey do as yu like, dey dress as yu like and dey go anywhere wey yu wont, but wen yu go old, yu go spread yor hand and oda pipol go help yu tie yor klot and karry yu go where yu nor won go.”
Wen e don katch Pita put for prison, e put four gangs, wey get four four soldiers each, make dem guide am. Herod plan na to bring Pita out make e judge am for di whole town front wen Passova don finish.
But Pita stand up with di eleven apostles kon shaut: “Judea pipol and una wey dey Jerusalem, make una put ear down for wetin I won tell una so. Make una know sey
Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka.
Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
but na God choose us to prish di gospel and na so wi dey prish am. Wi nor dey do am make pipol for praiz us, but make God wey dey si awa heart, praiz us by ensef.