Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 12:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Herod kon dey vex well-well for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si am. But dem kon first beg Blastus wey bi di king offisa, make e help dem beg am, bikos na di king kountry dey supply food give dia kountry.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 12:20
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Kanaan shidren na Sidon wey bi en first pikin, Het,


and dia land kon wide from Sidon to Gerar go rish Gaza and from der to Sodom, Gomorrah, Admah and Zeboiim till e rish Lasha.


Si, yor savants wey go kut di wood, I go pay dem with 20,000 bag of wheat, 20,000 bag of barley, 120,000 gallon of wine and 120,000 gallon of olive oil.”


Naw, make my oga send di wheat, barley, olive oil and wine as e promise kom give en savant;


So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.


To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.


Make yu dey sure sey dem advise yu well, before yu make any plan or go start war.


Nor kwik karry matter go kourt, bikos if anoda witness show sey na yu dey wrong, den, na wetin yu go do?


If yor oga dey vex for yu, make yu nor vex stop di work wey yu dey do, bikos gentol spirit dey korrect big mistake.


Judah and Israel pipol dey buy goods from una with wheat, honey, olive oil and spices.


“Di oga praiz di wayo manaja, bikos of di wayo sense wey e use. Bikos dis world pipol sabi use dia wayo sense for business pass pipol wey dey for lite.


Wen di day wey dem gri to meet am don rish, Herod kon wear en king dress and e kon sidan for en throne dey follow dem tok.


Afta wi rish Cyprus, wi kon leave der travel go Siria, kom stop for Tyre, bikos di ship won put load down.


Wi kontinue awa journey from Tyre go rish Ptolemais and wen wi don greet di brodas, wi stay with dem for one day.


E turn face Rama plus di strong-strong towns for Tyre, den e turn face Hosah kon end for di sea near Hebel, Akzib,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ