19 Wen Herod send pipol go find am and dem nor si am, e kweshon di sojas wey dey guide Pita kon kommand sey make dem kill all of dem. Den Herod komot from Judea go Caesaria go stay.
Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.
Wen di wise men don go, God angel kon tell Josef for dream, “Get up, karry di pikin and en mama run go Egypt, make una stay der until I go tell yu wetin una go do, bikos Herod won kill di pikin.”
Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.
Wen e don katch Pita put for prison, e put four gangs, wey get four four soldiers each, make dem guide am. Herod plan na to bring Pita out make e judge am for di whole town front wen Passova don finish.
But for di nite before dem go judge am, dem tie Pita with two shains and e sleep for two sojas centre. Oda sojas still dey di prison front, dey guide am.
Wen di warda wake-up kon si sey all di doors for di prison open, e bring en swod kom out, won kon kill ensef, bikos e tink sey all di prisonas don run.
Di next day, wi leave der kon go Caesaria. For der, wi enter Filip house. Dis Filip na evangelist and e dey among di seven deakons wey dem choose for Jerusalem, den wi kon stay der with am.