E use en hand take tell dem make dem kwayet and e kon tell dem how God take free am from prison. E tell dem, “Make una tell James and all di brodas dis story,” den e leave dem kon go anoda place.
Wen Herod send pipol go find am and dem nor si am, e kweshon di sojas wey dey guide Pita kon kommand sey make dem kill all of dem. Den Herod komot from Judea go Caesaria go stay.
Wen di warda wake-up kon si sey all di doors for di prison open, e bring en swod kom out, won kon kill ensef, bikos e tink sey all di prisonas don run.