6 As I look inside, I kon si animals wey get four legs, bush meat, di ones wey dey creep and difren-difren birds.
Jesus tosh di man eye again. Di man eye kon open and e kon dey si well-well.
Jesus klose di book kon gi-am back to di pesin wey dey hold am, den e go sidan. So evribody wey dey di sinagog kon dey look am.
Difren-difren animals wey get four legs and di ones wey dey creep for groun and difren birds dey inside di tray.
“As I dey pray for Joppa I kon si vishon. For inside di vishon, I si sometin wey bi like tray dey kom down small-small from heaven, dem hold am for four korna and e kon stop for my front.
I still hear one vois wey tell mi sey, ‘Get up Pita, kill some, make yu chop.’
but dem look am strait for eye kon sey, “Make yu look us!”