Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 11:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Afta dem don kontribute, dem kon send Banabas and Saul go give di eldas di money wey dem gada.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 11:30
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dat time, King Herod katch some pipol wey dey go church kon sey e go kill dem.


Banabas and Saul kon go back to Jerusalem wen dem don finish dia work and dem take John Mark follow body.


Wen dem don choose eldas wey go lead di bilivers for di difren-difren church, dem kon pray and fast sey, make God protet dem.


Wen Paul and Banabas don argue with di pipol well-well, di church pipol kon send Paul and Banabas with some oda pipol go Jerusalem go meet di apostles and di eldas, so dat dem go ask dem about di matter.


Na wetin dem rite for di leta, bi dis, “From di apostles and eldas wey bi una brodas, to all di brodas and sistas wey bi Gentile wey dey Antiok, Siria and Silisia. Wi greet una o-o!


Wen dem rish Jerusalem, di whole church with di apostles and di eldas kon welkom dem, den dem tell dem evritin wey God don use dem do.


Di apostles and di eldas kon whole meetin to tok about di matter.


As dem dey go from town to town, dem kon dey pass di message wey di apostles and eldas for Jerusalem send to all di Gentile pipol wey bilive Christ sey, make dem obey.


From Miletus, e send messenja go Efesus sey make di eldas wey dey di church kon meet am der.


Di next day, Paul kon follow us go si James and all di eldas wey dey der.


So Josef wey kom from Levi tribe and wey di apostles dey koll Banabas (wey mean pesin wey dey enkourage pipol) and en home-town na Cyprus,


Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.


Doz wey dey lead well, make dem pay dem well, especially doz wey dey work and tish well-well, so dat di gospel go stand.


Make yu nor asept any words wey dem tok against any leader, unless two or three pipol bear witness sey na true.


Titus! Na dis message make mi leave yu for Krete, so dat yu go kontinue awa work for der and pick new leaders for each town, just as I kommand yu.


If anybody among una nor well, make e koll di eldas for di church, make dem pray and use oil anoint am for Jesus name.


Mi wey bi una fellow elder, wey si how Christ sofa and go share for God glory wey go soon kom, dey beg di eldas among una sey:


Mi wey bi elder dey rite dis leta to di woman wey God choose, with en shidren wey I love inside di trut (nor bi only mi, but na evribody wey know di trut).


Mi wey bi elder dey rite dis leta to Gaius, my broda wey I love well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ