Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 11:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Wen di pipol for di church wey dey Jerusalem hear di news, dem kon send Banabas go Antiok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 11:22
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di apostles and di brodas wey dey Judea kon hear sey Gentile pipol too don receive God word.


All di pipol wey skata komot from Jerusalem for di time wey dem kill Stefen kon travel go far place like Foenicia, Cyprus and Antiok, dey prish give only Jew pipol.


But some among dem wey kom from Cyprus and Sirene kon go Antiok dey tok to di Greek pipol about di Good News wey koncern Jesus Christ.


and wen e si am, e kon take am go Antiok. Banabas and Saul stay der for one year dey tish di pipol wey dey di church and na for der dem for first koll di disciples, “Christians.”


For di same time, some profets kon go Jerusalem from Antiok.


Wen Paul and Banabas don argue with di pipol well-well, di church pipol kon send Paul and Banabas with some oda pipol go Jerusalem go meet di apostles and di eldas, so dat dem go ask dem about di matter.


So di apostles, eldas and di whole church kon gri sey dem go send some men follow Paul and Banabas go Antiok. Den choose Judas, wey dem dey koll Barsabas and Silas and dem bi leaders among di brodas.


and wen e rish, Caesaria pass go Jerusalem go salot di pipol for di church wey dey der, before e go Antiok.


Evribody like wetin di apostles tok, so dem kon choose one man wey en name na Stefen, bikos di Holy Spirit dey use am well-well. Di odas wey dem choose, na Filip, Prokorus, Nikanor, Timon, Parmenas and Nikolas wey kom from Antiok and e dey serve God like Jew pipol.


Wen di apostles wey dey Jerusalem hear sey Samaria pipol don receive God word, dem kon send Pita and John go meet dem,


So Banabas take Saul go meet di apostles, den e tell dem how Saul take si Jesus Christ for vishon wen e dey go Damaskus and how e bigin prish with boldness about Jesus Christ.


But wen Pita kom Antiok, I kon shalenge am, bikos wetin e do, nor good.


But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ