17 So my pipol, if God fit give doz Gentile pipol di same gift wey E give us afta wi bilive Jesus Christ, who I bi to stop God?”
Why yu dey akuiz God sey E nor dey ever ansa yor komplain?
“Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”
Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”
Di bilivers wey bi Jew wey follow Pita go Joppa kon sopraiz well-well sey Gentile pipol too, fit receive di Holy Spirit,
“Anybody go fit sey make wi nor baptize all dis pipol wey don receive di Holy Spirit, just like us?”
And wen I start to tok, di Holy Spirit kon enter dem, just as e enter us for di first time.
but if na from God, una nor go fit stop dem, escept una won fight God.”