Wen di wise men don go, God angel kon tell Josef for dream, “Get up, karry di pikin and en mama run go Egypt, make una stay der until I go tell yu wetin una go do, bikos Herod won kill di pikin.”
One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.
Den some sojas kon still ask am, “Wot of us? Wetin wi go do?” E tell dem, “Make una nor use force kollect money from anybody hand or lie for anybody head and make una salari, rish una.”
Make una nor disobey una masta, bikos dem bi bilivers. But make una serve and love dem well, bikos di mastas wey una dey serve, na Christian dem bi. Timoti, make yu tish dis tins and dey enkourage evribody to obey am.