47 “Anybody go fit sey make wi nor baptize all dis pipol wey don receive di Holy Spirit, just like us?”
As Pita still dey tok, di Holy Spirit kon enter inside all di pipol wey dey hear di message.
Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.
But wen dem bilive di Good News wey Filip prish about God Kingdom and about Jesus Christ, dem kon baptize di pipol wey bilive.
As dem dey go, dem kon rish where wota dey, naim di man sey, “Si, wota dey here! Wetin go make mi nor baptize naw?”
Jew and Gentile pipol nor dey difren for God eye and E dey bless evribody wey dey pray to am,
But leta, dem sekonsaiz am. Dis sign show sey, bikos of en faith, God don si am as raitious pesin, so dat e go bi papa to evribody wey bilive God, pipol wey God don asept, even doh dem neva sekonsaiz.