44 As Pita still dey tok, di Holy Spirit kon enter inside all di pipol wey dey hear di message.
“Anybody go fit sey make wi nor baptize all dis pipol wey don receive di Holy Spirit, just like us?”
And wen I start to tok, di Holy Spirit kon enter dem, just as e enter us for di first time.
And God, wey know wetin dey inside pipol mind, don show ensef to dem wen E give dem di Holy Spirit, just as E give us
and as Paul put hand for dia head, di Holy Spirit enter dem and dem kon start to speak difren language, dey profesai.
Wen dem pray finish, di place wey dem gada put kon dey shake. Di Holy Spirit enter all of dem and dem kon dey prish God Word with pawa.