Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis world nor go fit receive, bikos dem nor fit si am or know am, but una know am, bikos e dey stay inside una.
Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.
Den wen e follow dem sidan dey tok, e kon kommand dem sey, “Make una nor leave Jerusalem, but make una wait for di tin wey my Papa promise wey I don tell una before.