26 But Pita hold am kon sey, “Stand up, bikos I bi ordinary human being like yu.”
Na mi bi God and na my name bi dat; I nor go share my glory with anybody or let juju follow mi share my praiz.
Na my own hand I take make di eart foundashon kon spread di heavens with my rite hand and wen I koll dem, all of dem dey stand kom togeda.
Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”
Evritin for dis eart go woship am, even doz wey dia name nor dey for God Lamb book wey get life.
So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”