21 So Pita go down go meet di men kon sey, “Na mi bi di pesin wey una dey look for. Wetin bring una kom?”
Den Jesus ask am, “Wetin yu wont make I do for yu?” Di blind man ansa, “Tisha, make my eye open, make I for fit si again.”
Make yu get up go meet dem and make yu follow dem, bikos na Mi send dem kom.”
Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”
Na dis make wen una send pipol kom koll mi, I nor sey ‘No’. So make una tell mi, ‘Why una koll mi?’ ”