Jesus kon tell dem, “Na true sey una go fit drink from my cup, but e nor dey my hand to choose who go sidan for my rite and left, but na for doz wey my Papa choose.”
“Di day or di time wen dis tins go happen, nobody know am, even angels for heaven nor know and God Pikin sef nor know too. Na only di Papa, for heaven know am.
Dem go use swod kill some, karry some as prisona go anoda kountry and di Gentile pipol go distroy Jerusalem, until di time wey God sey Israel must sofa, go end.
Na di Oga awa God get all di sekret tins, but di tins wey E tell us, na for wi and awa shidren-shidren forever, so dat wi go fit obey all di words for dis law.