Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 1:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 So wen dem gada, dem kon start to ask Jesus Christ, “Oga God! Na naw yu go start to rule Israel?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 1:6
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


I go give una betta rulers with doz wey go advise una well just like di ones wey una get before. Den pipol go koll Jerusalem holy and faithful town.”


Since I don do dis tin, I go keep my kovenant with my savant Jakob and David shidren-shidren. I go choose one of David shidren-shidren make e rule ova Abraham, Isaak and Jakob shidren-shidren. I go sorry for my pipol kon make dem prosper again.”


Di pawa and great tins wey di world get, God kom gi-am to pipol wey dey serve am. Dia royal pawa nor go ever end and rulers go serve and respet dem.’


Dis tin show sey na so too Israel pipol go dey: dem nor go get king or leader; dem nor go do sakrifice or serve stone again and dem nor go get juju or image wey dem go use take konsult dia gods.


God sey, “For dat day, I go ribuild David kingdom wey fall. I go ripair en fence kon build am back. I go build am again kon make am bi as e bi before.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.


Jesus ansa, “Na true sey Elijah go first kom and e go ripair evritin.


Jesus kon ask am, “Wetin yu wont?” Di woman ansa, “Make yu allow dis my two boys sidan for yor kingdom, one for yor rite side and di oda for yor left.”


As Jesus sidan for Mount Olives, en disciples kom meet am for korna ask am, “Make yu tell us wen dis tins go happen? How wi go take know sey di time wen yu go kom, don rish?”


Jesus ansa dem, “True-true, Elijah go first kom, make e for prepare evritin. Naim make dem rite for God word sey, ‘Man Pikin must sofa many tins and dem must hate am?’


One day, di Farisee pipol kon ask Jesus wen God Kingdom go kom. Jesus ansa, “God Kingdom nor go kom with sign wen pipol go si


As Jesus dey waka near Jerusalem, e kon tell di pipol one parabol to show sey God Kingdom nor go just kom like dat.


So, I give una pawa to rule, just as my Papa don give mi.


Wen Pita si am, e kon ask Jesus, “Oga God, wot about dis man?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ